NaijaMatters
Would you like to react to this message? Create an account in a few clicks or log in to continue.

Akpos wife and the 100kisses

Go down

Akpos wife and the 100kisses Empty Akpos wife and the 100kisses

Post by Admin Mon Jul 18, 2016 12:15 am

Akpos travel
go
do business
for anoda
state, im
come write
letter to im
wife…..
My dear Sulia,
I no go fit send money dis
month oo because business no
dey too move, economy tight,
infact global market crisis dey
and don dey affect my business
performance so na 100 kisses I
dey send you. You be
my sweetheart, my honey, my
sweet potato abeg manage
and adjust.
Your loving husband Akpos
____________ _________ _________
_________ _________ _________ _________
_________ _________ _________ _________
______
His wife come reply am …
My dear Akpos, papa lolo, honey
mi. Thanks for di 100 kisses.
Below you go see list of
expenses wey I pay with di
Kisses…:
1. Obiora wey dey sell
provision agree give us
provision for one week for 2
kisses.
2. Di NEPA man agree say im no
go disconnect only after 7 kisses.
3. Oga landlord, Baba Tope dey
come every day dey collect 2 or
3 kisses instead of to dey take
monthly rent.
4. Aboki Rabiu wey dey sell
meat no dey take kisses so I
dey give am alternative
pleasures, I hope say you
understand.
5. Miscellaneous expenses, 40
kisses.
Please no worry about me oo I
still get balance of 35 kisses and
I go take am survive dis
new month using this balance…
Shall I plan the same for the
next month..???
Your Sweetie.pie
Sulia

Admin
Admin

Posts : 28
Join date : 2016-07-16
Age : 28
Location : abuja

http://naijamatters.greatestboard.com

Back to top Go down

Back to top


 
Permissions in this forum:
You cannot reply to topics in this forum